Wia dis foto come from, VISIONHAUS, MB MEDIA/GETTY IMAGES

Second Half

49' Tanzania players don wake up o, dem don begin worry Nigeria midfield.

Nigeria start dis second half wit action as dem dey surround Tanzania defence dey find goal.

47' Substitution for Nigeria Moses Simon don enta for Ademola Lookman, Moses Usor for Alhassan Yusuf.

46' Second half don start

First Half

Nigeria 1-1 Tanzania

45+5 First half don end

45' Chance! Nigeria get chance to score but Fredrick play di ball wey use go pastbdi net roof.

45' Referee add five minutes

45' Alex Iwobi play di corner kick wey meet Nigeria players but notin comeout as di ball end for Tanzania goalkeeper hand.

45' Dem don carry Ademola Lookman comot from field sake of injury.

43' Corner kick for Nigeria, Alex Iwobi dey wait to play am but Ademola Lookman dey for ground dey get treatment.

40' Nigeria captain Wilfred Ndidi fire shot as e bin try to score but di ball go wide.

36' Nigeria player Akor Adams shade Tanzania goalkeeper sake of say e hold di ball too much.

Mabula Msanga score for di Taifa stars as e dribble Nigeria defender Calvin baasey and anoda defender to score

32' GOALLLLLLLLL Tanzania don equalise

24' Nigeria player Alhassan Yusuf wey just score bin get anoda chance, e pass di ball to im teammate wey play di ball comot from di field.

20' Nigeria player fall for ground afta tackle from Tanzania player but e don stand up and game don continue.

15' Nigeria still dey control di ball but second goal neva come while Tanzania dey hustle to break Nigeria defence.

12' Nigeria player Alhassan Yusuf collect yellow card as e tackle Tanzania player.

10' Nigeria dey dominate do game so far as Akor no dey give di Taifa starts space to play di game.

7' Match don resume wit freeklick for Nigeria, dem play am toward goall but e go wide.

5' Tanzania player dey for ground dey collect medical attention afta e Nigerian opponent tackle am.

Nigeria 1-0 Tanzania

2' GOALLLLLLLL Alhassan Yusuf score for Nigeria. Alhassan Yusuf score afta Ademola Lookman pass ball give am.

1' Match don start

Line-ups

Nigeria: Nwabali (GK), Fredricks, Bassey, Aina; Ndidi, Bwene, Iwobi, Alhassan; Lookman; Adams, Nnadi

Tanzania: Manula (GK); Chilambo, Mwamnyeto, Mlingo; Mao, Miroshi, Msanga, Kachwele, Denis, Hamad, Mnoga.

End of content

Nigeria go play against Tanzania for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, on Friday for di third round of di 2027 Africa Cup of Nations (Afcon) qualifiers.

Nigeria lose dia last match in a surprising way, and dem go now hope to return to winning ways.

Tanzania never win any of dia previous matches, as dem manage to get only one point from dia two games.

Nigeria don win four, draw four and lose two of dia last 10 matches. Tanzania get one win, three draws and six defeats within di same period.

Dis difference make Nigeria look more likely to win di match, although Tanzania three draws show why one-goal winning margin fit be a reasonable expectation.

Discover more

Ginger Me

End of Ginger Me

Top Tori

Nigeria 1-1 Tanzania Afcon qualifiers live updates

Profile of pipo on Ghana new currency notes

Who be Faisal Maina wey court sentence to seven years in prison

Informate me

Di one wey dem dey read well well